Andrew Tate: Who be di influencer wey dem put under house arrest sake of serious allegations - BBC News Pidgin (2024)

Andrew Tate: Who be di influencer wey dem put under house arrest sake of serious allegations - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Getty Images

Romanian judge don place controversial internet influencer Andrew Tate under house arrest as prosecutors investigate new and serious allegations, including alleged sex wit a minor and allegedly trafficking underage pipo.

Im and im brother Tristan appear for court on Thursday afternoon. Dem place Tristan Tate under special judicial control.

Prosecutors bin ask di judge to remand di brothers in custody for 30 days while dem continue a new investigation involving a total of 35 alleged victims, including a woman wey be 15 for dat time.

For one statement, Romania agency against organised crime, DIICOT, tok say six pipo don dey detained in total, both Romanians and foreigners.

Andrew Tate bin make furious statement to di press despite say im say di case against am as a "stitch-up" and lies.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

"Dis na set-up. E dey absolutely disgusting. Thirty of dose girls say we neva do anytin wrong. Two na di mothers of our children, two neva even come here to Romania" e tok.

Di BBC ask am repeatedly about di allegations of sex wit one 15-year-old girl and trafficking underage pipo, but e bin walk away and refuse to reply.

Di Tate brothers bin dey previously charged wit human trafficking - and Andrew Tate charged wit rape - and dey awaiting trial on dose charges. Dem bin release dem from house arrest a year ago and dem tell dem say make dem no leave Romania.

Dem don always strongly deny any wrongdoing and deny di formal charges dem dey face.

Dis na new and separate allegations.

Di anti-organised crime agency tok say di accused bin dey groom "vulnerable" pipo, wey dem kon allegedly house in different locations and forced to produce p*rnographic material for online broadcast.

One of di foreign men chop accuse say im force a 17-year-old foreign citizen to "perform sexual acts" in order to make online video content. Dem say e allegedly keep all di $1.5m (£1.1m) profit. Di statement no name am.

Di same man chop accuse say e repeatedly have sexual relations wit one girl wey be 15 years old wen dem bin meet.

Afta questioning for several hours for di DIICOT offices, Andrew Tate tell BBC on Wednesday night say di latest allegations dey "pathetic" and say prosecutors dey "desperate". E say dem don "make up a lot".

E also tok say im dey accused of "lover-boying" di mother of im pikin dem - a technique wey criminals dey use to prey on victims vulnerabilities and den exploit dem.

One notorious misogynist wit a giant online following, Andrew Tate don refer on Twitter/X to di case against am as some kind of mainstream "conspiracy" to silence am.

For di new statement, prosecutors accuse di brothers of buying four luxury cars, and registering dem in di names of oda pipo in order to hide di proceeds of wetin dem describe as dia illicit activity.

In total, e dey alleged say di accused make some $2.8m through sexual exploitation.

Dose wey dem detain also chop accuse say dem attempt to intimidate di victims and witnesses.

During a 10-hour search of four properties on Wednesday, investigators seize cash and oda items, including luxury watches, laptops, hard drives and documents. Dem also impound 16 luxury cars.

Dem take di Tate brothers into custody late on Wednesday night afta questioning, along wit four Romanian citizens.

But to hold dem longer dan 24 hours, di prosecutors gatz bring dem bifor a judge, and di brothers appear in court hours later.

Who be Andrew Tate?

Andrew Tate: Who be di influencer wey dem put under house arrest sake of serious allegations - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Reuters

Dem born Tate wey im full name na Emory Andrew Tate for December, 1986.

Dem name am afta im papa wey bin work for di US Air Force for Britain and wey also bin dey work as chess master.

Im mama and papa meet for for d UK bifor dem go America wia Tate bin grow until im parents divorce.

Afta di divorce, Tate go Luton, England wit im mama.

Both Tate and im younger broda Tristan don claim say dem face poverty for England. Dem tok for interviews say dem bin dey go KFC to save oda pipo leftovers to fit chop later.

Tate bin win kickboxing world champion four times but na for internet e blow worldwide.

Tate don show for plenty videos, dey showcase im rich life wit cars private jets and yachts.

Shortly bifor dem arrest am for December 2022, e bin dey fight wit environmentalist Greta Thunberg for Twitter.

E claim say e get 33 cars and say e go send her a list of dia "respective enormous emissions".

On TikTok, videos with the #AndrewTate hashtag have been viewed billions of times. That figure also includes videos made by people criticising the influencer.

For TikTok, videos wey get di Andrew Tate hashtag don dey viewed billions of times. Dat number include pipo wey make video to call out and yab di influencer.

Wetin Andrew Tate tok about women?

For interview wit anoda YouTuber, e tok say e be "absolutely misogynist" and add say, "I be realist and wen you be realist you be sexist. You no fit dey rooted in reality andmake you nodeysexist."

For dat same video, e call women "intrinsically lazy" and tok say dem be "no such tin as independent female".

Andrew Tate don dey picked out by authorities for di effect im don get as e dey spread misogyny online for boys and young men for di UK.

Deputy Chief Constable Maggie Blyth tok for di launch of report into violence against women and girls for July 2024, say "we know say some of dis also dey linked to di radicalisation of young pipo online, we sabi di influencer, Andrew Tate, di element of influencing of particularly boys, dey quite terrifying."

Di report tok say di police dey now work wit counter-terrorism teams to combat di risks of young men wey dem dey radicalise.

Plenti social media platforms wey include YouTube, Facebook, Instagram and TikTok don ban am.

Tate bin dey banned from Twitter wen e say make women take responsibility say dem sexually assault dem. Dem don put am back for di platform wey dem dey call X now.

For one combative interview wit di BBC for June 2023, wen dem ask am weda im controversial views on women dey harm young pipo, di influencer claim say im be "force for good" and say im bin dey "act under di instruction of God to do good tins".

How Andrew Tate dey take make im moni?

Andrew Tate don call imself "self-made multi-millionaire" and say e dey make moni through "small webcam business from my house".

E tok for podcast interview say, "I bin get 75 women working for me from four locations and I bin dey make $600,000 a month from webcam".

For page for im website wey now dey deleted, e tok say e bring women enta di "adult entertainment industry".

E write for di page wey dem bin comot on February 2022, say, "my job na to meet girl, get some dates, sleep wit am, test if she be quality, make am fall in love wit me sotay she fit do anytin I say and den get am for webcam so we go fit make moni togeda".

Tate wit im broda Tristan tell di Daily Mirror say dia business na big scam wey men dey pay to follow women tok online.

"I don see men sell motor, TV.. dis guy grandma die and dem bin dey wait for di sale of di house. Wen dem sell di house finish, e go collect £20,000 ($26,200) wey im promise model to pay for her fake financial wahala," Tristan tell di Mirror.

Andrew Tate: Who be di influencer wey dem put under house arrest sake of serious allegations - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Free Storyboard Creator | Comic Strip Maker
Alp Consulting Ltd. hiring Senior software engineer LabView Teststand in Pune, Maharashtra, India | LinkedIn
Use Copilot in Microsoft Teams meetings
Bank Of America Financial Center Irvington Photos
Artem The Gambler
The Largest Banks - ​​How to Transfer Money With Only Card Number and CVV (2024)
Unitedhealthcare Hwp
Cumberland Maryland Craigslist
Here's how eating according to your blood type could help you keep healthy
Lesson 2 Homework 4.1
Hallelu-JaH - Psalm 119 - inleiding
Helloid Worthington Login
Taylor Swift Seating Chart Nashville
Sams Early Hours
What Happened To Maxwell Laughlin
Fairy Liquid Near Me
Clarksburg Wv Craigslist Personals
Youravon Comcom
Aspen Mobile Login Help
Schedule 360 Albertsons
Our History
Hyvee Workday
Anotherdeadfairy
Mini Handy 2024: Die besten Mini Smartphones | Purdroid.de
Craigslist Apartments In Philly
Discord Nuker Bot Invite
Finding Safety Data Sheets
Rek Funerals
Dubois County Barter Page
Bursar.okstate.edu
"Pure Onyx" by xxoom from Patreon | Kemono
Hotel Denizen Mckinney
Deleted app while troubleshooting recent outage, can I get my devices back?
Www Craigslist Com Shreveport Louisiana
Craigslist Neworleans
Tyler Sis 360 Boonville Mo
Helloid Worthington Login
Enjoy4Fun Uno
Td Ameritrade Learning Center
F9 2385
Armageddon Time Showtimes Near Cmx Daytona 12
Lacy Soto Mechanic
Miami Vice turns 40: A look back at the iconic series
The power of the NFL, its data, and the shift to CTV
Paul Shelesh
Login
Gon Deer Forum
Ucla Basketball Bruinzone
Jackerman Mothers Warmth Part 3
1990 cold case: Who killed Cheryl Henry and Andy Atkinson on Lovers Lane in west Houston?
Bob Wright Yukon Accident
Koniec veľkorysých plánov. Prestížna LEAF Academy mení adresu, masívny kampus nepostaví
Latest Posts
Article information

Author: Mr. See Jast

Last Updated:

Views: 6069

Rating: 4.4 / 5 (55 voted)

Reviews: 86% of readers found this page helpful

Author information

Name: Mr. See Jast

Birthday: 1999-07-30

Address: 8409 Megan Mountain, New Mathew, MT 44997-8193

Phone: +5023589614038

Job: Chief Executive

Hobby: Leather crafting, Flag Football, Candle making, Flying, Poi, Gunsmithing, Swimming

Introduction: My name is Mr. See Jast, I am a open, jolly, gorgeous, courageous, inexpensive, friendly, homely person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.